Please FOLLOW & LIKE our PAGE on:  

Lyrics Sammie Okposo – Shine and Proud

0
837
Shine and Proud - Sammie Okposo

Lyrics Shine and Proud By Sammie Okposo

For this our land, no matter our language
We be one, one family
Anywhere you look, anywhere you go
Blessings of God dey nyafu-nyafu
No place wey God bless like he bless our land o,
With mineral, oil and agriculture;
If na telecommunication o, or education o,
We don take am win award for the whole world,
We get the people, the power and possibility,
If you come out of this land you must be proud;
No be fighting and killing go solve our problem o,
Unity, peace, and love o, naim be the answer…

Thank you for reading this post, don't forget to subscribe!

When we remember wetin God don do for us o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
When we sing about the gudu-gudu things wey God don do for us o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
When we remember how God don stay for this our landi o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
After all the thing we don go through, we never go to war o
(Ehn… E dey make us shine and proud)

Also Download  Kanye West x Sunday Service Choir – Souls Anchored

E yeee, E yeee, E yeee, E yeee

I don talk am before o, no place like home
North, South, East and West o, home is the best
If na for fine (Hmm!), we fine trowe,
For soccer, music and film o, the world dey call our name o
No be say bad things never happen to us before o
But God let them happen o for us to learn some things
Cause the Bible say, “every disappointment na blessing o”
It is well o, I say it is well
God no make mistake when e give you your color
So abeg o make you leave am as e be
Cause even your color o, no be limitation o
You fit be anything you want to be
Now make we rise, na our time to shine o
God-u bless us o, no be small

Also Download  Gbenga Akinfenwa – JiJi Mo Ji

When we remember all the good things wey God don do o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
When we sing about the gudu-gudu things wey God don do for us o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
When we remember wey God dey bring us from o
(Ehn… E dey make us shine and proud)
O when we think about-u all the things wey God don do,
(Ehn… E dey make us shine and proud)

E yeee, E yeee, E yeee, E yeee (till fade)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here